-
Ojuelegba accident: Family of four follow die for di truck accident
Article information Author, Gift Andrew Role, Reporter Reporting from Lagos 3 February 2023 Wia dis foto come from, LASEMA BBC Pidgin don confam say one family of four follow die for di truck accident wey happun on Sunday, 29 January 2023 for Ojuelegba, Lagos Nigeria. Dem include di papa, mama, one male pikin and one female pikin from same family. Police tok tok pesin for Lagos Benjamin Hundeyin say di names of di family of four na Emeka Okoli (papa), Ifeyinwa Okoli (mama), Chidiebube Okoli (son) and Ifechukwu Okoli (daughter). Oda deceased victims wey Lagos goment release dia names na Basirat Olatokumbo King ‘F’, Blessing Isioma ‘F’, Abdulrahman Okoya Sunday…

